India election results 2024: Who be Rahul Gandhi, India main opposition leader wey Prime Minister Narendra Modi, Bharatiya Janata Party beat - BBC News Pidgin (2024)

India election results 2024: Who be Rahul Gandhi, India main opposition leader wey Prime Minister Narendra Modi, Bharatiya Janata Party beat - BBC News Pidgin (1)

Wia dis foto come from, Getty Images

Rahul Gandhi no just be di leader of di main opposition party for India, Congress. Im na also a member of di most famous political dynasty for India.

Im na di heir of di powerful Nehru-Gandhi political dynasty wey don dominate Indian politics for decades.

For 2004, Oga Gandhi bin run for office for di first time, for di constituency of Amethi in di state of Uttar Pradesh. E win and enta di lower house of India parliament wey dem dey call 'Lok Sabha'.

But im neva fit win general election for im party so far.

E bin suffer big defeat to Prime Minister Narendra Modi and im party, Bharatiya Janata Party (BJP) for di 2019 parliamentary election.

Skip Recommended articles and continue reading

Recommended articles

End of Recommended articles

Di 54-year-old neva be minister bifor, but im na still di most popular face for di opposition, mainly becos of im political background.

Early life

Dem born Rahul Gandhi on 19 June 1970, and im go di finest schools for India, study for US and work small for London before e return to work for Mumbai in 2002.

Pipo bin dey see am as person wey no too get interest for politics. Instead, na im sister Priyanka who pipo bin sure say na she go take over di mantle of power for di family.

Wen Gandhi decide to enta formal politics bifor di 2004 general election, e bin take many pipo by surprise.

Dem bin dey see am a shy pesin wey get more interests for cricket matches and outdoor life dan in political life.

India election results 2024: Who be Rahul Gandhi, India main opposition leader wey Prime Minister Narendra Modi, Bharatiya Janata Party beat - BBC News Pidgin (2)

Wia dis foto come from, Getty Images

A political royalty

Im great-grandpapa, Jawaharlal Nehru, na di first prime minister of independent India.

Im grandmama, Indira Gandhi, and im papa Rajiv Gandhi na former Prime Ministers for India also. Dem kpai both of dem seven years apart.

In September 2007, Gandhi become di secretary general of di Congress Party, wit im mama, Sonia, wey dem born for Italy, remaining as president. Sonia Gandhi na di Congress chief until poor health force am to hand over power to her son.

Dem appoint Rahul Gandhi as di Congress vice-president in 2013.

Di Congress party, wey di Gandhi family dey run, don rule India for more dan five decades. Dia dominance end in 2014 afta a defeat to di BJP.

Prime Minista Modi dey often accuse Gandhi say e dey play dynastic politics, and e dey sometimes refer to am as a "spoilt prince".

Trolling Rahul Gandhi

Oga Gandhi dey popular among di wider base of im party and pipo dey see am as di leader of Congress by 2014, but e formally become di president of di party in 2017.

Dis mean to say wen di party bin suffer im worst defeat ever 2014, wen dem win just 44 out of di 543 seat for India parliament, e become a target for mockery by di BJP.

Dem call am names like "pappu" (wey be nickname for 'small boy') or simpleton. Sabi pipo tok say im communication skills and frequent absences from di parliament make am look like leader wey no dey serious.

India election results 2024: Who be Rahul Gandhi, India main opposition leader wey Prime Minister Narendra Modi, Bharatiya Janata Party beat - BBC News Pidgin (3)

Wia dis foto come from, Getty Images

Stepping down

As di 2014 election dey bad, 2019 not too dey different; di Congress bin win only 52 seats.

Gandhi take personal responsibility for dat defeat and resign as leader.

E also lose im own seat for im family constituency of Amethi, for di northern state of Uttar Pradesh.

But as di Indian law dey allow pipo to contest two places for one election, Gandhi remain for Parliament afta im win a seat for di southern state of Kerala.

Even though oga Gandhi no be di official leader of Congress, im still dey very active for dis election. E dey make powerful speech for rallies, dey participate for road shows and dey hold meetings wit party workers and supporters.

E also dey travel to oda kontris, dey deliver lectures for prestigious universities, and dey hold tours to reach Indian communities around di world.

India election results 2024: Who be Rahul Gandhi, India main opposition leader wey Prime Minister Narendra Modi, Bharatiya Janata Party beat - BBC News Pidgin (4)

Wia dis foto come from, Getty Images

Marches

In January 2024, Gandhi embark on a 6,700 km-long march across India wey im bin call di “Bharat Jodo Nyay Yatra” (United India Justice March).

Di waka begin from Imphal city, wey be di capital of di north-eastern state of Manipur, and end for Mumbai.

Also, last year oga Gandhi bin do a 4,000km-long “unity march”, wen e travel from Kanyakumari in di south to Srinagar, wey dey Kashmir in di north.

Sabi pipo tok say di march na to breath new life into im own image and also di party.

But e neva dey clear weda dis marches go bring more votes and secure more seats for parliament.

E almost go prison

Last year, one court sentence Gandhi to two years in prison afta im link di prime minista surname wit two businessmen wey dia name na also Modi, wey India authorities bin declare wanted.

Gandhi claim say di charges against am dey politically motivated and dem carefully plan am before di general elections, but di goment deny di claims.

For now, di Supreme Court don suspend im conviction.

India election results 2024: Who be Rahul Gandhi, India main opposition leader wey Prime Minister Narendra Modi, Bharatiya Janata Party beat - BBC News Pidgin (2024)
Top Articles
Latest Posts
Article information

Author: Nathanael Baumbach

Last Updated:

Views: 5709

Rating: 4.4 / 5 (75 voted)

Reviews: 82% of readers found this page helpful

Author information

Name: Nathanael Baumbach

Birthday: 1998-12-02

Address: Apt. 829 751 Glover View, West Orlando, IN 22436

Phone: +901025288581

Job: Internal IT Coordinator

Hobby: Gunsmithing, Motor sports, Flying, Skiing, Hooping, Lego building, Ice skating

Introduction: My name is Nathanael Baumbach, I am a fantastic, nice, victorious, brave, healthy, cute, glorious person who loves writing and wants to share my knowledge and understanding with you.